Iya Basira
Dis na one buka wey I dey like to go. The food sweet so tey e go make your mind blow.
Day and night Iya Bass! How she do am I no no. Dem tink say na jazz, my brother no be so.
CHORUS
People people make una come e oh, iya basira e don jazz me oh, oh oh oh, everybody helep save me oh,
I no dey sabi chop either my mother or my girlfriends food,
People people make una come e oh, iya basira e go kill me oh, oh oh oh, everybody helep save me oh,
I no dey sabi chop at my mother or my girlfriends food.
VERSE 1
Wetin dey be say e get one day, wey I say I go play go see my paddy Sunday;
na so I reach there but Sunday he don high on beer,
luckily for me in junior brother eye e clear, so e say make we stroll through the area,
little did I know I was strolling to my burial right there where Oshodi bus dey load,
was a little buka, close to the main road. I laugh when e pass the door, he tell me say the name na
“Iya Bas” for short, but I bow when he order “iresi ati ewa, eran umum pure water
not even minerals. I come gree say I go manage to chop am,
before I realize I dey order second round, third round, fourth round,
I never still stop wetin Iya Basira e give me chop.
VERSE 2
You think say na play when I say that the way wey I dey
(wetin do am?)e no dey okay,wetin be your own advice,
I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice
even on my girlfriends birthday,
wey she dey wait make I take am to Ocean View,
I no know when I pass di place,
the only thing wey dey my mind na Iya Basiras palm oil stew,
kilon kilon sele sele, me I never see this kind, juju tele tele,
all those people wey go vex pele pele
but I hear say iya basira na xxxx xxxx
I sure say still I go go their go sit down
order my first round move to second round, third round, fourth round
I no dey ever stop. Wetin iya basira don give me chop?
BRIDGE
Officer abegi follow me to the place everybody don telle me I dey craze my girl friends don leave me, my mother no gree see me, my paddy hmm iya basira you don kill me.
Oya people people make una stop officer e don come (Policeman: where the woman?)
Woman: I dey inside, oga I dey come.
Policeman:
Woman wetin you dey give people chop wey dey cause all this wahala, casala oya make we talk.
Woman: Oga sir true to God nothing wey I dey put for the food wey I dey cook na God dey make am good.
Na which kind talk be that sey na God dey cook the food abi you think say I be fool, no be juju you dey put? In fact I dey suspect say na **** you wash put
sotey people dey queue come dey rush for your stew
Policeman: Well, to confirm am me I no mind make I chop small
give me fufu ninety naira plus dat soup wey dey draw..
chai correct this food sweet no be small she una no go vex if I still order for more
Woman: Officer no worry na de food be dis
Policeman: Oya people people make una go case dismissed.